Lyrics Page

Umbrella

By Moses Bliss

1,335 views Jul 16, 2026 updated Verified editorial review

Moses Bliss and Spotlite Nation's song 'Umbrella' is a vibrant Afro-gospel track celebrating God's protection and provision. The lyrics use the metaphor of an umbrella to describe being covered by God's care, with repeated affirmations that God is in control and more than able. The song expresses confidence in divine protection, referencing angels and the inability of enemies to harm the believer. It also touches on God's love, grace, and joy as sources of strength. The upbeat, declarative style is typical of contemporary African gospel music, emphasizing faith and thanksgiving.

Lyrics Verified by Editorial Team

Because my papa dey in control
I nor fit fail oh
He is more than able oh
Because my daddy dey for him throne
Observe my life oh
See the way e align oh

Because I'm under
I'm under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh

Because I'm under
I'm under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh

My daddy cover me
Cover cover cover
Give his angels charge over me
Over over over
Dem no fit koba me
Koba koba koba
Odeshi dey for my body

Wetin you see
Wetin you see
For my body
For my body
Wey you dey carry me go
Na you dey carry me go

I dey under the canopy
So I no get wahala
I get no p
When dem try to put am for my body e bounce
Cause Jehovah e cover me (cover me)

Your love no dey stop
E nor get e check point oh
Everything you do is on point oh
Lord na my head wey you anoint oh
Your grace no dey rest
E dey always dey follow me
Your joy be my strength
E dey power me
No other power fit to oppose me

Because I'm under
I'm under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh

Because I'm under
I'm under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh

Twenty-four seven
You be God
Na you get all power
I dey steady dey collect oh
Cause na your hotspot me I connect oh

If you check am
Oil dey my head
You dey see am wella
Olorun Oba na you set my ladder
Anytime I step inna the place na fire

By the grace of God
The gbedu dey sama
Planted by the waters I nor need mai ruwa
If you know my name
Omo na God dey do am
Amarachukwu jejely dey lift me higher higher

Under your canopy
Papa you cover me
Shey na you wey dey give me ability
I get your backing your agility
From now till eternity
(Till infinity)

My brother my sister
Na baba dey carry the boy go far
Anywhere I enter
Moves monumental
Inside him plans Na me dey for the center

Because I'm under
I'm under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh

Because I'm under
I'm under the umbrella
Na God dey run am for me
He is more than able oh

Because my papa dey in control
I nor fit fail oh
He is more than able oh
Because my daddy dey for him throne
Observe my life oh
See the way e align oh

Music Video

Save Your Favorites

Create a free account to save songs, build your personal library, and connect with the Zion community.

Create Free Account

Join the Zion Community

Create a free account to save your favorite lyrics, submit song suggestions, and connect with fellow worshippers.

No spam. Unsubscribe anytime.